You don hear?
Inside the explanation of Riyadus saaliheen wey our correct and confirmed Shaykh and Faqeeh Muhammad Saalih Al Uthaymeen RahimahuLlaah do, the Shaykh talk say "When Allaah loves an action, He go also love the bobo wey dey run am".
So as a matter of necessity, i wan use this medium to encourage and ginger my brothers with my sisters dem say this life wey we dey so, no be for us to dey shine eye like goat wey lick groundnut oil, rather make we wey dey arrange time to dey knack small small eebaadah, make we dey try do small small good things.
E get one confirm hadith wey anytime I dey reason am, e dey make belle dey sweet me tuelely as in ehn e make brain , infact the hadith enter class.
The hadith was collected by Imaam Bukhaariy RahimahuLlaah, even Imaam Muslim join collect the hadith, that is to say the hadith na ogbonge as in e authentic like say tomorrow no dey.... for the hadith the Prophet salallaahu alayhi was salaam talk say "there are two words wey Allaah the beneficent love well well, this two words light for tongue but dey get weight on meezan(scale of deeds)... the two statements na "subhanaLlaahi wa bihamdihi and subhanaLlaahi al adheem".
So even if na chenkele deeds like this we get power for, nothing spoil if we fit dey run am consistently e make sense because as you see Al-jannah so, na must to enter am o, no just reason carry last... although shaytan no go like let us see road but remember say e no get level.
so no belittle any good deed... to get Al jannah, All join (big and small).
As my warri people go yarn am say: at all at all na winch market!
may Allaah give us strength to dey do eebaadah and make He give us sincerity inside the small small ones wey we dey do.
Aameen.
una well done ummu Abdullah. jazakum lahu kaeran
ReplyDelete